Big Brother Naija (BBNaija) star, Deji, don comot talk say two of im expensive perfumes waka comot for Big Brother house wey e follow play last year 2022 edition.

Deji, wey carry im mata go Instagram share photo of di perfume, e write say make di pesin wey carry am for BBNaija house come return am back.
E list di two perfumes as “Blessed Barska” by Initio and “Promise” by Frederic Malle.
For im post, e write: “Still can’t believe I had 2 of my Pertumes stolen in big brother’s house; Blessed Baraka by Initio and Promise by Frederic Malle. Return am if na you move am.”
