Veteran Nollywood actress, Patience Ozokwo, don talk why some actors dey come online dey beg for financial help.
Remember say some actors don show face online to beg for money sake of dem health wey no dey okay.

The recent one na John Okafor, wey dem sabi as Mr. Ibu, wey come beg for help.
As Patience Ozokwo yan about why actors dey come out dey beg, she talk say many of dem dey spend their savings on top sickness when dem dey hope say dem go get better. But when the money no reach again, na im dem go come beg for help.
She add say many pipo dey reason say actors get money well well, and dem dey always expect to collect from dem, wey e dey make am hard for actors.
Finally, she talk say actors dey live big lifestyle wey dem dey call “packaging,” and na so dem go dey spend money, especially on top clothes, so dem no go dey wear the same thing again, and this one dey make dem financially down.