HomePiginCustoms Seize N13m Goods,...

Customs Seize N13m Goods, Promise to Catch Smugglers Well Well

Yola, November 21, 2023 – The Adamawa/Taraba Area Command of the Nigeria Customs Service (NCS) don yan say dem don seize items wey include 15,449 litres of Premium Motor Spirit (PMS) wey worth N13 million for Duty Paid Value.

Dem yarn dis one for one statement wey dem post for di NCS official X handle on Tuesday.

According to di statement, di Area Controller, Salisu Abdullahi, talk dis one for one press briefing wey happen on November 17, 2023, for di headquarters of di Area Command wey dey Yola.

Dem seize oda items join dis one, like 19 cartons of foreign insecticide and 26 bags of 50kg foreign parboiled rice.

Because PMS fit cause fire, di Comptroller yan say dem don dispose most of di product according to di law and dem don put di money wey dem get inside Federation Account.

Abdullahi talk say dem go sell di remaining part of di PMS wey dey ground after di press briefing.

E add say dem no catch any of di smugglers as all of dem run comot, but e talk say dem go catch all di smugglers because di country no fit allow people wey go spoil di economy.

Di comptroller yan Nigerians, stakeholders, and all di security agencies wey dey di command frontiers say make dem dey work with Customs to fight against di wahala of smuggling.

Download our official mobile app

Most Popular

More from Findwhosabi

Naira Struggles Again As Dollar Hits ₦1,610

The Dollar to Naira exchange rate is rising again. On Monday,...

Naira Drops Again As Dollar Hits ₦1,610

The Naira has dropped again. On Tuesday, April 22, 2025, the...

Dollar Hits ₦1,607 As Naira Falls Again

The dollar is now selling for ₦1,607 in the black market...

Naira Gains Strength, Closes Gap With Dollar

The naira showed signs of recovery in the parallel market on...