Federal Government don talk say dem don hold discussions with United Arab Emirates Ambassador to Nigeria, Salem Saeed Alshamsi, and Governor Uba Sani of Kaduna State to seek support for their school feeding programme.
Dem yarn dis one for one statement wey dem issue for Abuja on Wednesday through the Senior Special Assistant to President Bola Tinubu on School Feeding, Dr. Yetunde Adeniji.
Na one week after di FG talk say dem wan feed 100,000 displaced children for North, dis new tori come out.
Adeniji talk for di statement say her delegation meet with di UAE ambassador and di governor during di 52nd United Arab Emirates National Day celebration for Abuja wey happen on Monday.
She talk say both men show say dem dey ready to give total support for di humanitarian cause wey Federal Government dey run.
Di statement talk am like this, “We meet with His Excellency Salem Saeed Alshamsi Ambassador to di United Arab Emirates alongside Governor of Kaduna State, Uba Sani, and North Central Woman Leader of di APC, Princess Zara Audu during di 52nd United Arab Emirates National Day.
“We dey happy to yan say Kaduna State Government ready to assist di programme (school feeding) anyhow wey dey possible. Di governor dey proud of di programme and talk say Kaduna na one of di best states wey dem choose for such programme. Dem dey proud of themselves and wan continue to dey di best in line with our school feeding programme.
“Just like di Governor, di ambassador first commend di school feeding programme and di SSA for taking bold step to reach out to stakeholders. E also praise President Bola Tinubu-led administration for di initiative wey dem don already take to solve many wahala wey dey for di country.”