HomePiginIyanya yan say e...

Iyanya yan say e believe say Marriage dey sweet even if people dey divorce anyhow for entertainment.

Iyanya, wey be popular singer wey people sabi as Kukere master, talk say e believe say marriage dey sweet, even if plenty people for entertainment industry dey waka comot from their marriage.

The singer yan dis one for di latest episode of The Kingz Corner podcast. E talk say Nigerians suppose sabi how to waka pass bad marriages, so dat e no go dey control how dem dey see marriage.

Iyanya yarn say, “Marriage na better tin. We suppose sabi waka pass bad marriages. No allow bad marriages make you think say you no fit enjoy better marriage. I believe say if you see person wey love you wella and e ready to make sacrifice, e go dey sweet. I sabi people wey dey enjoy their marriage well, e no mean say dem no get challenge, but I don see how dem dey protect wetin dem get. Some people wey dey enjoy their marriage no dey too show am for Instagram; dem no dey post everything. Dem dey keep am, dem dey cherish am.

“Social media na two words; social and media. Your marriage na social? If you want make people dey happy with your marriage and small problem waka enter, you fit no fit make am up again.”

Download our official mobile app

Most Popular

More from Findwhosabi

Naira Struggles Again As Dollar Hits ₦1,610

The Dollar to Naira exchange rate is rising again. On Monday,...

Naira Drops Again As Dollar Hits ₦1,610

The Naira has dropped again. On Tuesday, April 22, 2025, the...

Dollar Hits ₦1,607 As Naira Falls Again

The dollar is now selling for ₦1,607 in the black market...

Naira Gains Strength, Closes Gap With Dollar

The naira showed signs of recovery in the parallel market on...