For Kwara Chief Magistrates Court for Ilorin, e don finally grant bail to Abdulazeez Adegbola wey dem sabi as Tani Olohun, wey be person wey dey follow traditional religion, afta e spend 91 days inside Federal Correctional Service for Ilorin, di state capital.
Tani Olohun bin dey trial for four different cases wey concern alleged defamation for three different courts for di state.
E bin dey detention since August 17, 2023, when dem bring am before Magistrate Mohammed Ibrahim on top five-count charges wey concern criminal conspiracy, inciting public disturbance, disturbance of public peace, criminal defamation of character, and intentional insult before di Chief Magistrate Court.
Di charge according to prosecution na based on sections 97, 210, 392, and 114 of di penal code law of Nigeria.
Tani Olohun don dey face similar charges for Kwara state Upper Area Court and two separate cases for di Chief Magistrate Court.
For di Magistrate Court presided over by Magistrate Adam on Thursday, dem give Tani Olohun bail of N2 million and three sureties wey go pay di same amount for di two different cases. Dem talk say two of di sureties must get land within di jurisdiction of di Court or for Oyo State where e talk say e dey live.
Tani-Olohun, while e dey talk for court, beg for forgiveness from Islamic scholars wey e allegedly defame and from all Muslims worldwide. E promise say e no go do dat kind thing again.
Di counsel to Tani Olohun, Mr. Ademola Bank, talk say e client don beg for forgiveness and dem go try meet all di bail conditions.