One man don share tori of how one Okrika vendor block am after e advise her to return huge amount of money wey she find inside bale of clothes wey she order.
Di man, wey be US consultant for admission, carry di tori go im Twitter handle, @UncleCCA, talk how he advise her to do di right thing.
According to am, she be im friend’s sister and she dey sell Okrika (thrifted) clothes.
For di recent bale of clothes wey she order, she see $1850, wey be equivalent of around 1.5 Million Naira.
He tell her make she return am as pikin of God, but now, he no fit see her WhatsApp status again and im messages no dey deliver. E con ask im followers wetin dey happen.
In im words:
“My friend’s sister wey dey sell Okirika, just find $

See some reactions…
@ubig1 said: “Unfortunately, you have been blocked. Asking her to return almost 2 million 😁 I’m sure she will call it a miracle 😂”
@originalucdivin asked: “Who will she return the money to? You deserve serious blocking, both on WhatsApp and in real life.”
@mrJaymi wrote: “If her left hand wants to cause her to sin, won’t she cut it off?”
@lolade_12 said: “You know how many “ bad bales” or “Nigeria packing bales” She don open ! Only people in the business can understand sha😊😊.”
@keshirobo asked: “I ask very respectfully: how exactly do you think ‘divine favor’ and ‘answered prayers’ look like?”