Nollywood actor, Nosa Rex, don waka enter social media to give advice to Israel DMW on how to fix im marriage wahala with im wife, Sheila.
Nosa, wey don spend eight years for marriage, talk say e don qualify to yan married men how dem go fit settle their palava.

E yan say for marriage these days, patience don dey scarce, and married people dey too dey conscious about their union.
According to Nosa, nobody marriage dey perfect, and e go make sense make couple date well before dem waka enta marriage.
On top the matter wey happen between Israel DMW and im wife, Sheila, Nosa criticize one influencer wey yan say Israel dey always prostrate for Davido.

Nosa talk say make Israel persevere for anytin wey dey put food for im table and dey give am level.
E advise Israel say make e try settle with im wife because na only if dem still get hidden secret wey fit cause split.