One pesin wey attend Rema show for UK talk say fear nearly carry her head during di stage performance of di Nigerian singer. Di show happun for O2 Arena on November 14th.

Rema wey be 23-year-old start di show on top horse, follow am waka for back of bat, and some of di images wey dem show she talk say e dey disturbing.
Di pesin talk say na di scariest moment wey she don ever experience for any musical event. She accuse Rema say e dey try use im alleged demonic presentation carry di soul of im fans.

She talk say, “No guys, I no get words for Rema concert. My vex be say all those things wey e dey do for fun na to carry us enta demonic matter. From when e start to dey chant, I no hear anything wey e talk. Even one girl wey I dey yan with talk say di whole time, she dey feel like pesin don carry her spirit. I start to pray; hell no; we come waka comot early.”