Blogger Tunde Ednut don waka enter him page, show us as Chioma, wey be Davido wife, take spend money for her outfit for the AWAY concert.
Chioma show face for her husband show for US, and this na her first time wey she show face for public since she lose her pikin Ifeanyi. People bin dey yan about her dressing.

After Tunde Ednut talk say Chioma outfit get fabrics wey cost millions, everywhere con dey buzz about how she sabi package.
Tunde write say:
“CHIOMA ADELEKE’S OUTFIT AT HER HUSBAND’S SHOW THIS PAST WEEKEND
LV 3D Mahina Monogram T-shirt dress 🟰 $2,900 GOYARD mini Saigon bag 🟰 $6,585.00 Lv trainers sneakers 🟰 $1,260 Richard Mille Wrist Watch 🟰 $260,000 2 Vancleef Bracelets 🟰$9,200
TOTAL 🟰 N280,000,000
All in one night.”