HomePiginYul Edochie: Nigerians Doubt...

Yul Edochie: Nigerians Doubt Say ladips Dey Alive

Actor Yul Edochie don observe say people no dey show interest for Oladips and hin music again, now wey e don prove say e dey alive. E talk say na fake love people dey show to the dead.

The matter wey carry kasala na when dis socialite wey sabi yan jara and movie star waka enter online come dey ask wetin don happen to the singer wey do PR stunt come fake hin death.

Yul Edochie yarn say e be like say people no dey post the musician again because e still dey alive. E talk say if Oladips truly die, people for dey post im photos and music every time.

Yul still yan say people dey show love pass to person when e don die than when e dey alive. Hin talk be say:

“Wetin dey happen to the guy wey fake hin death? Una no wan make e trend?

Nobody dey post am? Nobody dey post hin music because e still dey alive. If e don kpai for real, una no go gree make people rest.

Everybody go dey post hin picture and music.

To support person wey don die dey sweet una pass the ones wey still dey alive. Support am now wey e dey alive, jealousy and envy no go let una.”

Check the photo wey dey below …

Download our official mobile app

Most Popular

More from Findwhosabi

Naira Struggles Again As Dollar Hits ₦1,610

The Dollar to Naira exchange rate is rising again. On Monday,...

Naira Drops Again As Dollar Hits ₦1,610

The Naira has dropped again. On Tuesday, April 22, 2025, the...

Dollar Hits ₦1,607 As Naira Falls Again

The dollar is now selling for ₦1,607 in the black market...

Naira Gains Strength, Closes Gap With Dollar

The naira showed signs of recovery in the parallel market on...