HomePiginYul Edochie waka comot...

Yul Edochie waka comot im papa for recent party, gbege dey

Nollywood actor, Yul Edochie, dey chop hot insults as people yan say e neglect im papa, Pete Edochie, for one recent party, instead na junior actor, Alexx Ekubo, waka follow Papa Pete waka for the event.

During the premiere of the Afamefuna movie on Sunday, November 27, Nollywood stars, including Pete Edochie, Stan Nze, Blessing Obasi, Alexx Ekubo, and Kanayo O. Kanayo, show face for the event.

One video wey scatter everywhere from the event show how Alexx welcome and helep Papa Pete enta the venue, and people dey hail am for im gesture.

Some fans yan say dem dey vex with Yul Edochie as e suppose be the one to follow im papa.

Reactions from Fans:

  • elbinie: “The man dey show respect without stress.”
  • obadatofizzy: “Person wey suppose hold him papa hand Dey waka up and down.”
  • mojereolaikeoluwa: “Daddy abeg give uncle Y advice.”
  • tobadavidd: “This man get levels.. @yuledochie you no dey learn at all?”
  • itygirl: “@yuledochie you sure say na this man born you?”
  • engr.komasley: “Something wey Yul suppose dey do, e and Judy go dey do Isi mmili and Ijele for Instagram.”
  • avril8th_place: “I love the way Alex dey look after Papa Pete.”
  • tolusucre: “Person wey suppose hold him papa dey do fake chain waka up and down.”

Download our official mobile app

Most Popular

More from Findwhosabi

Naira Struggles Again As Dollar Hits ₦1,610

The Dollar to Naira exchange rate is rising again. On Monday,...

Naira Drops Again As Dollar Hits ₦1,610

The Naira has dropped again. On Tuesday, April 22, 2025, the...

Dollar Hits ₦1,607 As Naira Falls Again

The dollar is now selling for ₦1,607 in the black market...

Naira Gains Strength, Closes Gap With Dollar

The naira showed signs of recovery in the parallel market on...