News waka enta town talk say Mr Ibu wife, Stella Maris, carry police arrest di three people afta weeks of gbas-gbos for social media over di signature wey dey di actor account.
Nollywood actress, Doris Ogala, wey yan di tori for Instagram, talk say Jasmine and di actor sons dey Alagbon Police Station. Dem carry dem say Ibu wife accuse Jasmine say she transfer N300 million wey pipo contribute for Ibu medical matter.
“Ibu wife allegedly want make dem use di money buy house for am from di money wey pipo contribute for Ibu treatment. Na why she carry police go invite Jasmine. But investigation talk say di money wey pipo contribute no even reach N300 million,” she write.
But Chochoo yan our tori pesin on Thursday, confirm say di police invite di three people sake of di actor account.
“Yes, dem invite dem. I no go talk say na arrest; na di police invite dem sake of Mr Ibu account. But Val no dey involve as e no sabi wetin dey happen. E just return from abroad. I never fit reach any of dem,” Chochoo yan.
As we waka go meet Stella Maris for her comment on top di allegation, she talk say, “Abeg, I no want talk anything about am, abeg,” before she cut di call.
All di effort wey we use try reach Jasmine no work as di time wey I dey yan you, I never still fit reach am.
Okafor bin recently dey beg pipo for help sake of medical wahala wey e get. Di actor wey dem confam say e dey waka well-well afta plenty surgery, bin recent also cut one of im leg.