HomePiginSpaceX Starship: Second Try...

SpaceX Starship: Second Try Successful, Ship Dey Move Despite Booster Wahala

Boca Chica, Texas – SpaceX don knack second test for di big Starship rocket, wey Elon Musk dey plan use go Mars. Di rocket fly from Starbase for Boca Chica, Texas, around 7:00 am (1300 GMT) on Saturday. Even though di big booster waka commot and later scatter, di ship still dey move like dem plan am.

Starship wey tall reach 397 feet (121 meters) get power pass NASA’s Space Launch System (SLS). Dem design both systems to fit carry load waka many times without spoil, so dem fit reduce how much dem dey spend to launch.

E be like say wahala start when di booster scatter, but SpaceX talk say despite di yawa with di booster, di ship still dey do beta waka.

April time, SpaceX try di first launch for Starship wey be di big-big one, but e spoil yakata for Gulf of Mexico. Some people say dem no like wetin dem dey do, but Federal Aviation Administration don approve make dem try again.

Dem do some changes, like ‘hot staging’ wey mean say di upper stage engine go start even when e still dey with di booster. Dis one dey common for Russian rocket way dem feel use add more power. Dem still arrange beta arrangement to reduce chance wey e fit explode.

The first time wey dem launch dis big rocket, e scatter di place, spoil di launchpad for Starbase. Dem don fix am sote dem use strong concrete, and dem get system wey go use water protect dem from di big heat and force wey dey happen during launch.

Download our official mobile app

More from Findwhosabi

Naira Struggles Again As Dollar Hits ₦1,610

The Dollar to Naira exchange rate is rising again. On Monday,...

Naira Drops Again As Dollar Hits ₦1,610

The Naira has dropped again. On Tuesday, April 22, 2025, the...

Dollar Hits ₦1,607 As Naira Falls Again

The dollar is now selling for ₦1,607 in the black market...

Naira Gains Strength, Closes Gap With Dollar

The naira showed signs of recovery in the parallel market on...
Exit mobile version