Di Nigerian singer, Zlatan Ibile don share di last chat wey im get with im best friend, Oladips, few hours before e die.
Oladips death na di latest gist for town, wey dem talk say e die afta serious sickness.
Zlatan Ibile, wey neva tok since di sad news, finally talk how e take pain am as e lose im best friend, wey dem two start dia music career together.
For di throwback photo wey Zlatan share, e emphasis on how e pray make e hear good news afta dem bin yarn on top im health matter.
Zlatan Ibile post am say: “Cried all night and prayed to God that I hear a good news this morning. Here I am and I’m never going to see my friend again.”