HomePiginPresodo Tinubu Hail...

Presodo Tinubu Hail Jonathan, Wish Am Happy 66th Birthday

Presido Bola Tinubu don send birthday greetings to former Presido Goodluck Jonathan as e celebrate hin 66th birthday. Tinubu talk say Jonathan wisdom, foresight, and patriotism dey inspire leaders wey wan make better change for Naija and even beyond.

Tinubu Special Adviser for Media and Publicity, Ajuri Ngelale, talk for one statement wey e sign on Sunday. The statement wey dem title ‘President Tinubu celebrates icon of democracy, Dr. Goodluck Jonathan, at 66,’ talk say Tinubu hail Jonathan for hin achievement as leader and how e carry Naija and Africa shine for democratic level.

Tinubu talk say Jonathan humility still dey give hope for good leadership for Naija and Africa as a whole. Tinubu talk say Jonathan get beta leadership profile, from Deputy Governor, Governor, Vice-President, and Presido. Now, Jonathan still dey push for peace for Africa, dey bring leaders together and dey advise dem on how dem fit live well together for di benefit of di people wey dem dey serve.

Tinubu hail Jonathan for how e dey work to serve humanity and dey strengthen democratic institutions. E talk say make God continue to give Jonathan and hin wife, Patience, beta health and strength as e clock 66.

Download our official mobile app

More from Findwhosabi

Naira Struggles Again As Dollar Hits ₦1,610

The Dollar to Naira exchange rate is rising again. On Monday,...

Naira Drops Again As Dollar Hits ₦1,610

The Naira has dropped again. On Tuesday, April 22, 2025, the...

Dollar Hits ₦1,607 As Naira Falls Again

The dollar is now selling for ₦1,607 in the black market...

Naira Gains Strength, Closes Gap With Dollar

The naira showed signs of recovery in the parallel market on...
Exit mobile version